Lebanon explosion: Authorities stop ‘injured’ Nigerian domestic worker wey survive blast from leaving di kontri

Authorities for Lebanon don stop five Nigerians from leaving dia kontri ontop di evacuation flight wey goment bin arrange on 12, August, 2020.

Inside message she send to BBC, Nkiru wey injure for di Beirut blast wey kill more dan 100 pipo say dem lock her and four oda pipo inside room and stop dem from boarding di flight say dia madam report dem.

"We reach airport now to board flight goment arrange and dem say dem no go allow us go, 5 of us, dem say our madam report us because we comot from madam house. Dem say dem no go allow us, we don beg but dem no allow us, dem dey throway our tins."

"If you no hear from me again, know say dem don put me for prison, if you no hear from me, know say dem don collect everything from me and put me plus injury wey I get for prison." Nkiru tok.

English | August 12, 2020

COMMENTS

SUPPORT OUR WORK

We depend on your donation to fight for domestic workers in Lebanon.